-
Mark Chapter 1
John Di Baptist Clear Road For Jesus As Dem Take Baptize And Tempt Jesus 9. Dat time, Jesus come from Nazareth for Galilee, and John Baptize am for Jordan. 10. As Jesus dey komot from di water, he con see as heaven open, naso di Spirit land for hin body like dove. 11. One voice con halla from heaven, “Dis na my correct pikin wey I love; wey dey make belle sweet me.” 12. Naso di Spirit con carry am go inside desert, 13. and he dey for inside desert for forty days. Na for there Satan tempt am. He dey wit wild animals, but angels give am moral. As Jesus Take Call…
-
Mark Chapter 2
Jesus Heal Pesin Wey Paralyze As He Take Call Levi 13. Jesus waka komot again—near di river. Plenty pipo come meet am, and he start to dey teach dem. 14. As he dey waka dey go, he con see Levi, Alphaeus pikin, he sidon for tax collectors office. Jesus con tell am sey, “Follow me,” Naso Levi stand up, con follow am. 15. As Jesus dey chop night- food for Levi house, many tax collectors plus sinners con sidon wit am, plus hin disciples, dem plenty wey follow am. 16. Wen di Pharisees wey be teachers of di law see am dey chop wit sinners plus tax collectors, dem con…