-
Luke Chapter 17
Always Forgive Jesus Heal Ten Pipo Wey Get Leprosy 11. Now, as Jesus dey go Jerusalem, he travel for di border between Samaria and Galilee. 12. As he enta inside di village, ten men wey get leprosy come meet am. Dem stand far-far, 13. con dey halla wit loud voice, “Oga , Jesus, sorry-for us!” 14. Wen Jesus see dem, he tok sey, “Make una go show unasef to di priest.” And naso dia body heal as dem dey go. 15. As one of dem see sey he don heal, he come back, con dey praise Baba-God wit loud voice. 16. He throway hinsef for Jesus front, con dey tank…
-
Luke Chapter 18
Di Parable Of Di Widow Wey No Wan Gree Di Parable Of Di Pharisee, Plus Di Tax Collector 9. Dis parable wey Jesus gist dem na for those pipo wey dey form sey dem holy, and wey dey carry shoulder up: 10. “Two men go di worship-place [church] go pray, one na Pharisee, and di oda one na tax collector. 11. Di Pharisee stand up con dey pray about hinsef: ‘Baba-God, I tank you sey I no be like oda men—robbers, evil doers, men wey dey climb pipo wife—or even like tax collectors. 12. I dey fast two times a week, and I dey give tithe of everitin wey I…