-
Luke Chapter 23
Dem Carry Jesus Go Meet Pilate As Dem Take Kill Jesus 26. As dem dey carry Jesus komot, dem hold Simon from Cyrene as he dey come from di kontri-side, naso dem use gra-gra make am carry di cross follow Jesus. 27. Plenty pipo follow am, plus women wey dey cry and dia eyes don full wit water. 28. Jesus turn, con tell dem sey, “Daughters of Jerusalem, make una no cry for me; cry for unasef, and for una pikin. 29. Time go reach wen una go tok sey, ‘Blessings for di women wey no get pikin, di belle wey neva born pikin and di breast wey neva feed…
-
Luke Chapter 24
As Jesus Take Rise Up From Di Dead For Di Road To Emmaus 13. For dat same day two of dem dey go one village wey dem dey call Emmaus wey be about eleven miles from Jerusalem. 14. Dem dey gist wit each oda about everitin wey don happun. 15. As dem dey tok and dey gist di mata wit demsef, naso Jesus hinsef just show-face, con dey waka wit dem; 16. but dem no first know sey na Jesus be dat. 17. He con ask dem, “Wetin una dey tok as una dey waka dey go so, wey una dey feel sad?” 18. One of dem wey dem dey…