• John Chapter 1

    Di Word Turn To Huma Being John Di Baptist Tok Sey He No Be Di Christ 19. Dis na   wetin   John tok—wen di Jews send priests and Levites from Jerusalem —con ask am who he be. 20. He no keep quiet, but he tok hin mind, “No be me be di Christ.” 21. Dem con ask am, “Who you con be? You be Elijah?” He sey, “I no be am.” Dem still ask, “You be prophet?” He con ansa dem, “No.” 22. Las-las dem con tok sey, “So who you be? Ansa us so dat we go know wetin we go tell di pipo wey send us. Tell us about…

  • John Chapter 2

    Jesus Turn Water To Wine Jesus Clear Di Worship-place 12. Afta dis, Jesus go Capernaum wit hin mama plus hin brodas, and hin disciples. Dem stay there for some days. 13.Wen time don almost reach for di Jews Passover, Jesus go Jerusalem. 14.For inside di worship-place, he see some men wey dey sell malu, sheep, plus doves—and some odas wey sidon for table dey change moni. 15.So he use rope take make koboko, con pursue all of dem komot from di worship-place area, both sheep plus  malu; he scata di coins of di pipo wey dey change moni, con throway dia table. 16.Naso he tell all those pipo wey dey…