-
Luke Chapter 21
Di Offering Of Di Widow Sign Sey Time Don Dey Reach 5. Some of di disciples dey tok about how dem take build di worship-place wit fine-fine stones, and wit gift wey pipo give to Baba-God. But Jesus tok sey, 6. “As for wetin una dey see for here so, time dey come wen no single stone go dey on top of each oda; all of dem go scata for ground.” 7. Dem con ask am sey, “Teacher, wen dis tins go happun? And wetin go be di sign sey dem go soon happun?” 8. He ansa dem sey: “Make una watch well-well so dat dem no go play una…
-
Luke Chapter 22
Judas Agree To Sell Jesus Di Last Night-food 7. Di day of di Unleavened Bread con reach wey dem suppose sacrifice di Passover lamb. 8. Jesus send Peter and John sey, “Make una go arrange place for us to chop di Passover.” 9. Dem con ask am sey, “Where you wan make we go arrange?” 10. So he ansa dem sey, “As una dey enta di city, one man wey dey carry container of water go meet una. Follow am go di house wey he go enta, 11. and make una tell di owner of di house sey, ‘Di teacher dey ask: where di visitors room, where I go fit…