• John Chapter 11

    As Lazarus Take Kpeme Jesus Comfort Di Sistas 17. As he reach there, Jesus notice sey Lazarus don already dey inside grave for four days. 18. Bethany no reach two miles from Jerusalem, 19. and plenty Jews come meet Martha and Mary to tell dem sorry—for dia broda wey die. 20. Wen Martha hear sey Jesus dey come, she go outside go meet am, but Mary dey for house. 21. Naso Martha tok sey, “Oga, if to sey you dey for here, my broda for no die. 22. But I know sey even now—Baba-God fit give you anytin wey you ask am.” 23. Jesus con tell her sey, “Your broda…

  • John Chapter 12

    Mary Anoint Jesus For Bethany Jesus Enta Like King 12. Di next day, plenty-pipo wey come for di Festival—hear sey Jesus dey for road dey come Jerusalem. 13. Dem carry branches of palm tree go meet Jesus, dem con dey halla, “Hosanna!” “Blessings for di Pesin wey dey come in di name of Baba-God!” “Blessings for di king of Israel!” 14. Naso Jesus see one small donkey, he con sidon on top am, as dem write am for di Holy- books sey, 15. “Oh Daughters of Zion, no let fear catch una; see una king sidon for donkey—dey come.” 16. First of all, hin disciples no understand all dis tins.…