-
John Chapter 17
Jesus Pray for Hinsef Jesus Pray For Hin Disciples 6. “I don show you those pipo wey you give me from dis world. Na you get dem; you give dem to me, and dem don obey your word. 7. Now dem know sey everitin wey you don give me—come from you. 8. I give dem di message wey you give me, and dem accept am. Dem sure well-well sey I come from you. And dem believe sey na you send me. 9. I pray for dem. I no dey pray for di world, but for those pipo wey you don give me, dem belong to you. 10. Na you get…
-
John Chapter 18
Dem Arrest Jesus Dem Carry Jesus Go Annas 13. Naso di sojas and dia commander, plus di Jews official con gbab Jesus. Dem tie am, 14. con carry am go meet Annas wey be di fada-in-law of Caiaphas – di high priest dat year. 15. Caiaphas nahin advise di Jews sey e go beta if one man die for di pipo. Peter First Deny Jesus 16. Simon Peter and anoda disciple dey follow Jesus. Becos di high priest know dis disciple, he follow Jesus enta di high priest palace, 17. but Peter wait for di doormot. Di oda disciple wey di high priest know—come back, he tok wit di girl…