-
John Chapter 21
Jesus Show-face for Galilee You Love Me? 15. As dem chop finish, Jesus tell Simon Peter sey, “Simon, son of John, you really love me pass all dis pipo?” Simon ansa, “Yes, Oga, you know sey I love you.” Naso Jesus tok sey, “Give my lamb food to chop.” 16. Jesus still tok sey, “Simon, son of John, you true-true love me?” He ansa am, “Yes, Oga, you know sey I love you.’ Jesus con tok sey, ‘Take care of my sheep.” 17. Di third time Jesus tell am again, “Simon, son of John, you love me?” Peter feel bad, becos Jesus ask am di third time, “You love me?”…
-
Acts Chapter 1
Di Promise Of Di Holy Spirit Jesus Raise Go Heaven 6. So wen di disciples gada togeda, dem ask Jesus sey, “Oga, abi na dis time you go bring back di kingdom of Israel?” 7. Jesus con tell dem sey: “Una no fit know di time and date wey my Papa don set wit hin pawa. 8. But una go recieve pawa wen di Holy Spirit enta una; and una go tok about me for Jerusalem, and for di whole Judea, plus Samaria, even reach di end of di earth.” 9. Afta he tok finish, naso he move go up for dia korokoro eyes, one cloud con block am make…