-
Acts Chapter 4
Peter And John For Front Of Di Council Di Prayers Of God-pipo 23. As dem release Peter and John, dem go back to dia own pipo, con gist dem everitin wey di chief priests plus senior-men tell dem. 24. Wen dia pipo hear am, dem start to raise dia voice togeda, dey pray to Baba-God. Dem tok sey, “Oga, na you be Baba-God, wey make di heaven and earth, plus di big-river, and everitin wey dey inside dem. 25. You tok wit Holy Spirit, tru di mouth of your servant—awa Papa David: “ ‘Why di nations dey para, and di pipo dey waste dia time dey plan? 26. Di kings…
-
Acts Chapter 5
Ananias And Sapphira Di Disciples Heal Plenty-pipo 12. Di disciples do plenty miracle signs, plus wonders among di pipo. And all God-pipo con dey meet togeda for Solomon Veranda. 13. No oda pesin get mind join, dem even though di pipo respect dem well-well. 14. No-do-no-do, more and more men plus women believe Baba-God, and dem con plenty more-more. 15. Becos of dat, pipo carry plenty sick pipo come street, dem lie down for bed and mats, so dat Peter shadow go cover some of dem—as he dey waka pass. 16. Plenty-pipo gada sef from all di towns wey dey around Jerusalem, dem bring dia sick pipo, plus those pipo…