• Acts Chapter 6

    As Dem Take Choose Di Seven Dem Gbab Stephen 8. Now Stephen, na man wey brekete wit Baba-God grace and pawa. He do ogbonge wonders, and miracles among di pipo. 9. Some pipo con change-am-for am—some members of di worship-place wey dem dey call ‘Freedmen’—Jews from Cyrene, Alexandria, and around Cilicia and Asia. Dis men start to dey follow Stephen argue, 10. but dem no fit reason reach di level of Stephen wisdom, or di Spirit wey he dey use tok. 11. Dem codedly beg some men make dem tok sey, “We don hear Stephen dey bad-mouth Moses and Baba-God.” 12. So di senior-men plus di teachers of di law…

  • Acts Chapter 7

    Stephen Tok Wit Di Council Dem Stone Stephen 54. Wen dem hear wetin Stephen tok, dem vex for am seriously. 55. But Stephen, wey brekete wit di Holy Spirit—look up go heaven, naso he see Baba-God levels, and Jesus wey stand for Baba-God right hand. 56. He con tok sey, “See, I see heaven open, and Man-pikin dey stand for Baba-God right hand.” 57. Naso dem close dia ears—dey halla, dem con rush am, 58. dem drag am komot from di city, con start to dey stone am. Dem drop dia clothes for front of one young man wey dem dey call Saul. 59. As dem dey stone am, Stephen…