• Acts Chapter 20

    Paul Go Macedonia And Greece Dem Raise Eutychus From Di Dead For Troas 7. For di first day of di week, we gada togeda to share bread. Paul tok wit di pipo, and becos he plan to komot di next day, he tok reach midnight. 8. Plenty lamps dey for di upstairs room were we dey do di meeting. 9. One guy wey dem dey call Eutychus sidon for window, he con dey sleep as Paul dey preach. Wen he don sleep go far, he fall from di three storey go down—he con kpeme. 10. So Paul rush go down, he bend down, con put hin hand round di guy.…

  • Acts Chapter 21

    Movement To Jerusalem Paul Reach Jerusalem 17. As we reach Jerusalem, di brodas welcome us well. 18. Di next day, Paul and di rest of us go see James, and all di senior-men dey for there. 19. Paul greet dem, con gist dem di full tori of wetin Baba-God don use hin work do—among world-pipo. 20. Wen dem hear am, naso dem praise Baba-God. Dem con tell Paul sey: “Bros, you see how many thousands of Jews wey don believe, and all of dem over- serious to follow di law. 21. But dem don tell di Jews believers wey dey here for Jerusalem sey—you teach all di Jews wey dey…