-
Acts Chapter 22
Paul Wey Be Roman 22. Di plenty pipo listen to Paul until he tok dis tin. Naso dem con dey raise dia voice, dey shout, “Carry am go kill! He no suppose dey alive!” 23. As dem dey shout, dey tear dia cloth komot, and dey throw dust for air, 24. di commander con tok sey make dem carry Paul enta di barracks. He tok sey make dem flog Paul, and ask am question so dat dem go know why di pipo dey shout for am like dis. 25. As dem stretch am make dem flog am, Paul con tell di soja wey dey stand for there sey, “E dey…
-
Acts Chapter 23
Paul Follow Di Council Tok Di Plan To Kill Paul 12. Di next morning, di Jews plan codedly, con swear sey dem no go chop or drink anytin until dem kill Paul. 13. More dan forty men join dis plan. 14. Dem go meet di chief priests, plus di senior-men, con tok sey, “We don swear sey we no go chop anytin until we kill Paul. 15. Now make una and di Council beg di commander—sey make dem carry Paul come tomorrow—like sey una wan ask am more question about am. We don ready to kill Paul before he reach here.” 16. But wen Paul sista pikin hear wetin dem…