-
Romans Chapter 16
Greetings Paul Ginger Di Holy-pipo To Gum-body 17. I dey beg una, brodas—watch out for those pipo wey wan divide una, and block una road—pipo wey no dey follow di teaching wey una don learn. Maek una no near dem. 18. All those kain pipo no dey serve awa Oga Jesus Christ, but na dia belle dem dey serve, and wit whyning and sweet-mouth dem dey scam di heart of innocent pipo. 19. Everi-pesin don hear as una take dey obey Baba-God, so I dey happy becos of una; but I wan make una get-sense to do di right tins, and to dey innocent—for evil tins. 20. And Baba-God of…
-
1st Corinthains Chapter 1
Tanks-giving 4. I dey always tank Baba-God for una, becos of di grace wey una get—as una belong to Jesus Christ; 5. sey for inside everitin, he don make una rich—for inside yarnings, and to know everitin. 6. becos una don confam di words of Christ inside una. 7. So, una no dey lack any spiritual gift, as una dey wait for awa Oga Jesus Christ—make he show-face. 8. He go keep una strong kakaraka, reach di end, so dat una no go get any error—on dat day wen awa Oga Jesus Christ go 9. Baba-God dey faithful—di God wey call una to rub-mind wit hin Son, Jesus Christ awa…