-
1st Corinthians Chapter 14
Gift of Prophecy And Tongues Beta Worship 26. Wetin we go yarn brodas? Wen una come togeda, everi-pesin get song, or teaching, or some pipo wan speak in tongues and some wan interpret, and some wan show us sometin. Una must do everitin so dat di church go grow. 27. Make e no pass two or three pipo wey go speak in tongues; make dem tok one afta di oda and make one pesin interpret wetin dem tok. 28. If interpreter no dey, make di pesin wey dey tok keep quiet for inside church, and make di pesin speak in tongues to hinsef, and Baba-God. 29. Make two or three…
-
1st Corinthians Chapter 15
As Christ Take Rise Up Di Dead Go Raise Up Again 12. But if dem preach sey Christ don raise up from di dead, how come some of una dey tok sey pipo wey don die no go raise up again? 13. If pipo wey don die no go raise up again, dat means—even Christ no raise up. 14. And if Christ no raise up, awa preaching no make sense, and naso una faith dey useless; 15. so we apostles—go dey lie about Baba-God, becos we don tok about Baba-God—sey he raise Christ from di dead. But dat message no go be true, if di dead no go raise up.…