-
2nd Corinthians Chapter 2
Forgiveness For Sinners 5. But if any-pesin don cos pain, he no make me feel bad, but he make una feel bad reach one level—make I no put am in a harsh way. 6. Di punishment wey plenty of una don give am, don dey okay for dat kain man. 7. Now instead, una suppose forgive am, con comfort am, so dat he no go feel too bad for hinsef. 8. So, I dey beg una, make una let am know sey una still love am. 9. Nahin make me dey write to una—to test una and see whether una go obey everitin. 10. If una forgive any-pesin, me sef…
-
2nd Corinthians Chapter 3
Di Levels Of Di New Promise 7. But if di law of Moses wey bring death, wey dem write for stones—get levels, sote di pipo of Israel no fit steadily look Moses face, becos hin face dey shine well-well wit Baba-God levels, even as di light don dey fade, 8. abi di new way of di Spirit no go get more levels? 9. If di old way of di law wey dey condemn men—get levels, dat mean sey di new way of righteousness—go get more levels. 10. Dat first levels no get levels now, if you compare di levels of di new way—wey get levels yanfu-yanfu. 11. And if di…