-
2nd Corinthians Chapter 4
Beta-beta-tins For Inside Clay Pot
-
2nd Corinthians Chapter 5
Awa Heavenly House Di Office of Peace Maker 11. So, since we understand sey we must serve Baba-God wit fear, we dey try to beg pipo. Baba-God know us wella, and I hope sey una sef go know us well. 12. We no dey try to tok sweet tins about awasef to una again, but we dey give una chance to use us make-mouth, so dat una go fit ansa pipo wey dey feel big wit high position and achievement, instead of wetin dey inside dia heart. 13. If we get scoin-scoin as some pipo dey tok, na becos of Baba-God; if awa mind dey alright, na for una gain.…