• 2nd Corinthians Chapter 6

    1. So, as pipo wey dey hustle for Baba-God togeda, we dey beg una—make una no collect Baba-God gift—con waste am. 2. He tok sey, “For time wey I ready to accept una, I hear una, and for di day of salvation, I epp una.” Baba-God don ready to accept una now. Today-today na di day of salvation. Paul Suffer-head 3. We no dey offend any- pesin in any way—so dat pipo no go bad-mouth awa work. 4. Instead, for everitin, we dey confam awasef as servant of Baba-God; inside serious patience, wahala, suffer-head plus yawa, 5. wen dem beat us, wen we dey inside prison—inside katakata, hard work, nights…

  • 2nd Corinthians Chapter 7

    1.  My love, since we don get all dis promises, make we clean awasef from everitin wey dey spoil awa body and spirit, and make we use di fear of Baba-God take make awa holiness perfect. Happiness Wey Paul Get 2. Open your heart to us. We neva offend any-pesin, we neva corrupt any-pesin, we neva play any-pesin wayo. 3. I no dey tok all dis tins to condemn una; I don tok am before sey, una dey inside awa heart—to die and live wit una. 4. I don follow una tok wit full mind; I dey use una make- mouth well-well. Una don ginger me, and I dey happy…