• Ephesians Chapter 1

                               Spiritual Blessings Inside Christ 3. Blessings for di God and Papa of awa Oga Jesus Christ, wey don bless us for heaven level wit everi spiritual blessing, becos we belong to Christ. 4. Just as he choose us inside am before di foundation of di world, so dat we go dey holy and wit-out error—inside love, for hin front. 5. E don tey wey he plan awa destiny—to accept us as hin pikin tru Christ Jesus, based-on di sweetness of hin will, 6. to di praise of di levels of hin grace, wey he accept us put—inside hin Love. 7. Na inside am we take get salvation tru hin…

  • Ephesians Chapter 2

    Alive Inside Christ One Inside Christ 11. So, make una remember sey before-before una wey dem born as be Gentiles [world-pipo]—dem dey call una, “uncircumcised pipo”—by di pipo [Jews] wey call demsef “di circumcision” [na sometin wey dem dey do for body wit human being hands]. 12. Remember sey dat time, una no bin dey wit Christ, una no bin dey among pipo wey Baba-God don choose, and una be jjc to di agreement of di promise wey Baba-God make to hin pipo. Una live inside dis world wit no hope, and wit-out Baba-God. 13. But now, una belong to Christ Jesus, una wey bin dey far- far—don come near…