-
Ephesians Chapter 3
Paul Wey Be Preacher To Di Gentiles Prayer For Di Ephesians 14. Becos of dis, I go kneel down for front of di Fada of awa Oga Jesus Christ, 15. wey call di whole family for heaven and earth by dia name. 16. I pray sey from hin riches wey yanfu-yanfu, and wey get levels—he go ginger una wit pawa inside—tru hin Spirit. 17. Naso Christ go stay for inside una heart as una put faith on am. And I pray sey una go get root wey stand gidigbam inside love. 18. And make una fit understand, wit all God- pipo—how wide and long, plus how high and deep—di love…
-
Ephesians Chapter 4
Unity Inside Di Body Of Christ To Dey Live As Pikin Of Di Light 17. So na wetin I dey tok and yarn inside Christ: Make una no dey live like world-pipo again—wit dia useless reasoning. 18. Dia understanding dark well-well, and dem don waka far from di life of Baba-God, becos dem be olodo, and becos dia heart don close. 19. Dem no-send again, dem don give dia life to sex anyhow, and to do all evil tins wit longatrot. 20. But una no know Christ wit dat kain way. 21. Since, you don hear about Christ, and you don learn di truth wey dey inside Jesus, 22. throway…