-
Ephesians Chapter 5
Husbands And Wife 22. Wives, obey your husband as you take dey obey Baba-God. 23. Husband na di head of di wife, just as Christ na di head of di church. Christ na di Saviour of di church wey be hin body. 24. Now as di church dey obey Christ, naso wives sef must obey dia husbands for everitin. 25. Husbands, love una wives, just as Christ take love di church, con sacrifice hin life for her, 26. to make her holy and clean, he clean her by washing her wit water of di good news. 27. He do am so dat he go carry di church give hinsef-as church…
-
Ephesians Chapter 6
Papa, Mama, Plus Pikin Oga and Worker 5. Workers, obey your oga for dis world, wit fear and shaking, and serve dem wit clean-heart, just as you go obey Christ. 6. Obey dem—no be just becos you want dia favour wen dem dey look you, but like servant of Christ, do di will of Baba-God from your heart. 7. Serve dem wit seriousness, as if you dey serve Baba-God and no be man, 8. becos you know sey Baba-God go pay everi-pesin—for everi good tin wey e do, whether he be worker, or oga. 9. And oga, treat your workers in di same way. No threaten dem, since you know sey na…