• Philippians Chapter 1

    Tanks-giving Plus Prayer 3. I dey tank Baba-God everi time wey I remember una. 4. Any time I pray, I dey always pray wit happiness for all of una, 5. becos una join di work of di good news—from di first day reach now. 6. And I dey sure of dis very tin; sey Baba-God wey start beta work inside you— go complete am, until di day of Jesus Christ. 7. So e dey right for me to feel dis way about all of una, since I dey tink about una for my heart. Whether I dey in chains, or I dey defend myself, and confam di truth about di…

  • Philippians Chapter 2

    Make Una Copy Christ Humbleness Hustle Your Own Salvation 12. So my correct padi, as una dey always obey, no be only for my front, but even wen I no dey around—kontinu to dey hustle for una salvation wit fear and shaking, 13. Baba-God nahin dey work inside you, both to make you wish, and to make you do di tins wey dey make belle sweet am. 14. Do everitin wit-out complaining or argument, 15. so dat you go dey perfect and innocent—Baba-God pikin wey no get error—inside dis evil and corrupt generation—wey you dey shine among dem like stars for dis world. 16. Hold di word of life tight—so…