• 1st Thessalonians Chapter 1

    Tanks-giving For Di Thessalonians’ Faith 2. We dey always tank Baba-God for all of una, as we dey call una name inside awa prayers, 3. We dey always remember una work of faith, and una hustle for love, plus di endurance of hope—inside awa Oga Jesus Christ, and for front of awa God and papa. 4. Brodas we know sey Baba-God love una, and he don choose una. 5. Wen we bring di good news come meet una, no be only wit just yarnings, but wit pawa sef, plus di Holy Spirit, and wit full mind; as una confam di kain men wey we be among una, just becos of…

  • 1st Thessalonians Chapter 2

    Paul Work For Thessalonica Paul Wan Really See Di Thessalonians 17. My pipo, as we fisikally komot from una side small, but awa heart still dey wit una, body scratch us well-well to come meet una. 18. So, we wan be come meet una, but me—Paul, I try to come everi time, but Satan no gree us. 19. Aftall, wetin be awa hope, or happiness, or di crown wey go make us happy? Abi no be una, for Oga Jesus front wen he go land? 20. True-true, na una be awa levels and happiness.