-
1st Thessalonians Chapter 3
Stand Gidigbam Inside Christ Timothy Words Wey Dey Ginger 6. But now wey Timothy don come meet us from una, and he don bring beta gist about una faith and love. He don tell us sey una dey always remember us wit beta way, and sey una wan see us—just as we sef wan see una, 7. so brodas, inside all awa wahala, and palava—una ginger us becos of una faith. 8. Na now we really dey live—becos una don stand gidigbam for Christ. 9. How we fit tank Baba-God reach for una, for all di happiness wey we get for Baba-God front becos of una, 10. as we dey…
-
1st Thessalonians Chapter 4
To Live Make Baba-God Body Sweet Am As Christ Go Take Come 13. My pipo, we wan make una know about wetin go happun to God-pipo wey don sleep, so dat una no go feel sad like oda pipo wey no get hope. 14. If we believe sey Jesus die, con raise up again, naso Baba-God go take bring Jesus wit di pipo wey don sleep inside Christ. 15. Based-on wetin Jesus don tok, those pipo wey don sleep no go carry las among di pipo wey still dey alive until awa Oga come. 16. Di Oga hinsef go come down from heaven wit loud voice, wit di voice of…