-
1st Thessalonians Chapter 5
Tiff For Night Las-las Advice 12. My pipo, biko respect those pipo wey dey serve among una—wey dey lead una inside Christ, and wey dey correct una, 13. respect dem fully wit love becos of dia work, and make una live in peace wit unasef. 14. And we dey beg una brodas, warn those pipo wey dey do anyhow, ginger pipo wey no get strong heart, epp pipo wey no- strong, and dey patient wit everi- pesin. 15. Make sure sey una no do bad to those pipo wey dey do una bad, but always hustle for beta tin for yoursef, and for everi-pesin. 16. Always dey happy; 17. No…
-
2nd Thessalonians Chapter 1
Thanksgiving Plus Prayer 3. Brodas, we no fit stop to dey tank Baba-God for una, as e make sense, becos una faith don dey grow more-more, and di love wey all of una get for unasef dey burku. 4. We dey use una make- mouth among Baba-God churches, for una patience plus faith inside all di pepper wey dem dey show una, and di suffer-head wey una dey face. 5. All dis one na evidence sey Baba-God judgement dey right, and so dat Baba-God go count una among pipo wey get levels reach—for hin kingdom, wey una dey suffer for sef, 6. since na good tin for Baba-God to use…