-
2nd Timothy Chapter 3
Evil For Di Last Days Live Holy Life 10. But una don use jeje follow my teaching, my way of life, my mission, faith, patience, love, endurance, 11. as dem show me pepper, my suffer-head-and di kain tins wey happun to me for Antioch, Iconium and Lystra, see as I endure di kain pepper wey dem show me, but Baba-God save me from all of dem. 12. Yes, dem go show everi- pesin pepper—wey wan live good life inside Christ Jesus, 13. but evil men and fake- pipo go bad more-more, dem go play pipo wayo and pipo go play dem wayo sef. 14. But you must kontinu di tins…
-
2nd Timothy Chapter 4
Pesina Comment 9. Try your best make you come meet me sharply, Timothy. 10. Demas don fashi me go Thessalonica, becos he love di tins of dis world. Crescens don go Galatia and Titus don go Dalmatia. 11. Na only Luke dey wit me. Carry Mark follow-body come, becos he go epp me wella for my work. 12. I send Tychius go Ephesus. 13. Bring di cloth wey I leave wit Carpus for Troas. Carry my books come, and especially di papers. 14. Alexander di iron worker—don do me bad tin well- well. Baba-God go pay am back for wetin he don do. 15. Make you sef dey watch out…