• Titus Chapter 1

    Titus Work For Crete 5. Di reason wey I leave una for Crete, na becos I wan make una arrange wetin remain, and make una choose senior-men for everi town as I bin tell una 6. if na pesin wey no get error, man wey get only one wife, man wey hin pikin dey faithful, and wey pipo no fit tok sey dem be jaguda or sey dem dey do anyhow. 7. Since Baba-God don put hin work for church leaders (bishop) hand, he must dey perfect—he must be man wey no dey reason only hin own way, he must be pesin wey no dey quick vex, pesin wey no dey…