• Titus Chapter 3

    Do Beta Tin Las-las Yarnings 12. As soon as I send Artemas or Tychicus come meet you, try come meet me for Nicopolis, becos I don decide to spend di cold season for there. 13. Sharp-sharp epp Zenas di lawyer, plus Apollos—for dia journey, and make sure sey dem get anytin wey dem need. 14. Awa pipo must sabi maintain beta tins, so dat dem go fit epp odas wey need epp urgently, and make dem no live useless life. 15. Everi-pesin wey dey wit me—dey send dia greetings. Greet those pipo wey love us inside di faith. Make grace dey wit all of una. Iseee.

  • Philemon Chapter 1

             Paul Dey Beg For Onesimus Tanks-giving Plus Prayer 4. I dey tank Baba-God as I dey always call your name for my prayers, 5. I dey hear about your love and faith wey you get for Oga Jesus, and your love for all God- pipo, 6. As una dey share una faith wit odas, I pray sey make una sabi all di blessings wey Christ Jesus don give us. 7. My broda, your love don give me serious happiness and moral, and your kindness don ginger di heart of God- pipo. 8. So, even though I fit use full-mind to dey command you to do wetin you suppose do, 9.…