-
Hebrews Chapter 3
Jesus Great Pass Moses Warning Against Pipo Wey No Gree Believe 7. So as di Holy Spirit tok sey: “If you hear hin voice today, 8. no make your heart strong [no get coconut-head] as Israel pipo bin do wen dem rebel, for di days of dia temptation for inside desert. 9. Una papa test me, con try my me, and dem see my works for forty years. 10. Na wetin make me para for dat generation, I con tok sey, ‘Dia heart dey always waka miss- road, and dem no sabi my ways.’ 11. So I swear as I dey vex, ‘Dem no go enta inside my rest.’ ”…
-
Hebrews Chapter 4
Sabbath Rest For God-pipo Jesus Na Di Ogbonge High Priest 14. So, since we get ogbonge high priest wey don waka enta di heavens—Jesus wey be Baba-God Son, make we hold di faith tight—wey we dey tok about. 15. We no get High priest wey no fit feel sey we no-strong, but he face temptation for everi point, just as we sef face temptation—but he no still commit sin. 16. So make we waka go di king-chair of Baba-God grace wit full-mind, so dat we go fit receive mercy, con see grace wey fit epp us wen we need am.