-
Hebrews Chapter 5
Warning Make Una No Fall Komot 11. We get plenty tins to tok about am, but e dey hard to explain becos una no dey hear word. 12. True-true, by dis time, una don suppose dey teach pipo sef, but una still need pesin to dey teach una simple truth of Baba-God word. Una be small small pikin wey need milk, no be meat wey strong! 13. Any-pesin wey still dey drink milk, na small pikin wey neva sabi di pure yarnings. 14. But strong food na for mature pipo wey sabi use dia sense and experience take understand both good and evil.
-
Hebrews Chapter 6
Baba-God Promise Na Sure- banker 13. Wen Baba-God promise Abraham, since no-pesin great pass am wey he go use swear. He use hin own name take swear, 14. sey, “I go surely bless you, and I go make you spread.” 15. So afta he wait wit patience, Abraham receive wetin Baba-God promise am. 16. Men dey swear wit pesin wey great pass dem, and oath wey pipo take to confam wetin dem tok—dey settle kwanta. 17. Baba-God don swear wit oath, so dat those pipo wey receive di promise go dey sure sey he no go ever change hin mind. 18. So Baba-God don give us promise and oath. Baba-God…