• Hebrews Chapter 12

               Baba-God Dey Correct Hin Sons Warning Make You No Fashi Baba-God 14. Try to live in peace wit all men, and live holy life; wit-out dem—no-pesin go see Baba-God. 15. Make una make sure sey no-pesin miss di grace of Baba-God, so dat no badbelle root go grow, con cos katakata and spoil plenty pipo. 16. Make sure sey no-pesin dey sex anyhow, or pesin wey no dey fear Baba-God like Esau—wey sell hin birth-right as senior pikin becos of plate of food. 17. Later, as una know, wen he wan collect hin papa blessing, dem reject am. He too late for am to repent, even wen he cry…