• James Chapter 1

    Test and Temptation 2. My pipo, make una reason am as pure happiness—any time wey una face different tins wey dey test una faith, 3. As you know sey wen your faith don pass tru test—nahin fit make am get patience. 4. But allow patience do e perfect work, so dat you go dey perfect and complete, and you no go need anytin. 5. If any one of una need wisdom, make e ask Baba-God wey dey give am wit open- heart—to everi-pesin, wit-out seeing comma wit di pesin—and he go give di pesin. 6. But wen you ask, you must believe, and no get two- mind, becos pesin wey…