• James Chapter 2

    Warning Against Partiality Faith And Works 14. My pipo, wetin be di gain, if pesin claim sey e get faith, but you no get action [or works]? Abi hin faith fit save am? 16. If to sey one broda or sista no get cloth, or food to chop everi day, 17. and one of una tell am sey, “Go, I wish you well; take care of yoursef and make you chop belleful,” but you no do anytin about wetin di pesin need fisikally, which kain good be dat? 18. Naso e be sef, faith wit- out work na die. But pesin go argue sey, “You get faith, and I get…

  • James Chapter 3

    To Control Di Tongue Di Original Wisdom Na From Baba-God 13. Who dey wise, con get understanding among una? Make he show am wit hin good life, sey he dey do hin works wit jeje wey dey come from wisdom. 14. But if una dey keep serious jealousy, and selfish plan for una heart, no use am make- mouth, or lie against di truth. 15. Dis kain wisdom no dey come from heaven, but na from earth, e no dey spiritual, and na from bad-spirit. 16. Where envy and selfish plan dey, na for there you go see jaga-jaga plus everi evil ways. 17. But di wisdom wey dey come…