-
James Chapter 4
Give Yoursef To Baba-God To Dey Make-mouth About Tomorrow 13. Now make una listen, you wey dey tok sey, “Today or tomorrow we go travel go dis or dat city, spend one year for there, do business, con make moni.” 14. As if you even know wetin go happun tomorrow. Wetin be your life? You be like cloud wey just show-face, and small time e go vanish komot. 15. Instead, you suppose tok sey, “If Baba-God wish, we go dey alive to do dis or dat.” 16. As e be so, you dey make-mouth, and you dey carry shoulder up. To make-mouth like dat—na evil tin. 17. Any-pesin wey…
-
James Chapter 5
Warning For Bigman Wey Dey Oppress Pipo Patience Inside Suffer-head 7. So, make una dey patient, until Jesus go show. See as farmer take dey wait for di land to produce e beta fruit, and as di farmer take dey wait wit patience—for di first and last rains. 8. Make una sef dey patient, and stand gidigbam, becos awa Oga Jesus Christ no go tey come. 9. Make una no dey grumble about each oda, or you go dey condemned. Di judge dey for doormot! 10. My pipo, wen you face suffer-suffer, use di prophets wey yarn wit Baba-God name as example of patience. 11. We count those pipo…