• 1st Peter Chapter 1

    Di Hope of Everlasting Life 3. Praise to Baba-God, di Papa of awa Oga Jesus Christ! Based-on how Baba-God take sorry-for us well-well—he don make us born again, to live wit hope—as he raise Jesus Christ from di dead. 4. And we get beta-beta- tins wey Baba-God keep for heaven for us, wey no go ever spoil, or kpafuka, or fade. 5. Baba-God pawa dey protect you tru your faith inside di salvation wey dey ready to show for di last day. 6. So make you happy well-well, even though you must endure different temptations for short-time. 7. Dis temptations go show sey una faith na real faith wey get value…

  • 1st Peter Chapter 2

    Di Living Stone Plus Di Pipo Wey Dem Choose 4. You dey come meet Christ wey be di living stone—wey men fashi, but wey Baba-God choose, and wey fine well-well to am. 5. He dey build una like living stone sef, to be spiritual house, as holy priest—wey dey give spiritual sacrifice wey Baba-God go accept tru Jesus Christ. 6. Di Holy-books tok sey, “See, I dey lay foundation stone for Zion, precious foundation wey I choose, and wey precious, and shame no go ever catch any-pesin wey believe am.” 7. Now, dis one na to una wey believe, dis stone precious. But to those pipo wey no believe, “Di…