-
1st John Chapter 5
Faith Inside Di Son of God Las-las Yarnings 13. I dey write dis tins to una wey believe in di name of Baba-God Son, so dat una go know sey una get life wey dey last forever, and so dat una go kontinu to believe in di name of Baba-God Son. 14. And we get dis full- mind for Baba-God, sey he dey hear us—any time we ask anytin—wey go make belle sweet am. 15. And since we know sey he dey hear us any time we ask am, we know sey he don already do wetin we ask from am. 16. If any-pesin see hin broda dey commit sin…
-
2nd John Chapter 1