-
3rd John Chapter 1
-
Jude Chapter 1
Di Sin and Yawa of Men Wey No know Baba-God 3. My love, as I bin serious to write una about di salvation wey we dey share, but I see sey e dey important to write to una, to ginger una to seriously fight for di faith wey Baba-God don give hin holy- pipo once and for all. 4. Some kain men wey don condemn tey-tey—don use style join una churches. Men wey no dey fear Baba-God, wey dey change Baba-God grace to dey sex anyhow, and dem don fashi di only Baba-God wey be awa Oga, and awa Oga Jesus Christ. 5. I know sey una don already know…