Psalm Chapter 146

Abeg share
  1. Praise Baba-God, Praise Baba-God, Oh my soul.
  2. I go praise Baba-God all my life; I go sing praises to Baba-God as long as I dey alive.
  3. Make you no put your trust on bigmen; dem no fit epp you.
  4. Wen dia spirit comot, dem go go back to ground; on dat day dia plans go fade.
  5. Blessed na di pesin wey trust di God of Jacob for epp, wey hin hope dey for Baba-God awa
    Oga.
  6. Nahin make di heaven plus earth, di sea and everitin wey dey inside am. Baba-God dey
    faithful forever.
  7. He dey fight for pipo wey dem press down, and he dey give food to pipo wey dey hungry.
    Baba-God dey free prisoners,
  8. Baba-God dey make blind pipo see, he dey carry pipo up—pipo wey bow down dia head.
    Baba-God get love for righteous pipo.
  9. Na Baba-God dey watch over foreigners, and dey keep pesin wey no get palee and woman
    wey no get husband. But he dey dabaru wicked pipo ways.
  10. Baba-God dey-on-board forever, your God, Oh Zion, for all generation. Praise Baba-God.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *