Psalm Chapter 147
Praise Di Oga Kpatakpata
- Praise Baba-God. E dey good to sing praises to awa God, e make- sense and praise dey beautiful.
- Baba-God dey build Jerusalem, he dey gada di outcast of Israel.
- He dey heal pipo wey dia heart don break, and he dey treat dia wound.
- He know how many stars wey dey for sky, and he dey call all of dem wit dia name.
- Awa God dey great, and he get ogbonge pawa! Dem no-fit measure hin understanding.
- Baba-God dey carry humble pipo go up, but he dey nack badbelle pipo for ground.
- Sing to Baba-God wit tanks giving; use di harp [musical instrument] take sing praises for awa God.
- He cover di sky wit cloud; he give di earth rain, and make grass grow for di mountains.
- He dey provide food for wild animals, and food to di young raven—wen dem call am.
- No be di strength of horse, or di pawa of man leg—dey make am happy;
- Baba-God dey happy for those pipo wey dey fear am, for those pipo wey put dia hope sey he go sorry-for dem.
- Oh Jerusalem, make una praise Baba-God; Oh Zion, praise your God!
- He dey make di thick iron for your gate strong kakaraka. And he don bless di pipo inside you.
- He make peace dey for di borders, and make you belleful wit di best wheat.
- He send hin command to di earth; hin word dey run sharp- sharp.
- He dey give snow like wool, con scata di small-small-ice like ashes.
- He send hin ice-stone come down like small rocks. Who fit stand for where hin cold dey?
- He send hin word and dem melt, he ginger hin breeze to blow, and di water to flow.
- He don show hin word to Jacob, and he don show hin law and command to Israel.
- He no treat any oda nation like dis; and dem no know hin laws. Make una praise Baba-God!