Leviticus Chapter 11
Animal Wey Clean Plus Animal Wey No Clean
2. “Tell di pipo of Israel sey: ‘Out of all di animals wey dey live for di land, na dis ones you fit chop:
3. Una fit chop any animal wey bottom of e leg divide like malu leg, and we dey bring back food from e belle to chew.
4. E get some oda animals wey bottom of dia leg divide like malu leg, or only dey bring back food from e belle to chew, una must no chop dem. Like camel, even though e dey bring back food from e belle to chew, but bottom of e leg no divide like malu leg. Dat kain animal no clean for una.
5. Even though rock hyrax dey bring food back from e belle to chew, e leg no divide for under like malu leg; di animal no clean for una.
6. Rabbit dey bring food back from e belle to chew, but e leg no divide for under like malu leg; di animal no clean for una.
7. And pig, even though e leg divide for under like malu leg, but e no dey bring food back from e belle to chew; so di animal no clean for una.
8. Una must no chop dia meat or even touch dia deadbody. Dem no clean for una.
9. Of all di animals wey dey live inside water, whether na for big-rivers, or river, una fit chop anytin wey get fins and scales.
10. But these ones among di plenty animals wey dey for inside water na tufiakwa to una; everitin for inside water wey no get fins plus scales go be tufiakwa for una.
11. Dem go be tufiakwa for una, una must no chop dia meat, and una must no near dia deadbody.
12. Everitin wey dey for inside water wey no get fins and scales go be tufiakwa for una.
13. To add-join, una must forbid dis birds, and una must no chop dem becos dem be tufiakwa: eagle, vulture wey get bear-bear, black vulture,
14. Kite, plus any kind of falcon,
15. Any kind of raven,
16. Ostrich, di screech owl, gull, and any kind of hawk,
17. Di small owl, cormorant, di great owl,
18. White owl, desert owl, and osprey,
19. Stork, any kind of heron, di hoopoe, and bat
20. Una must no chop dem any insect wey dey fly and wey dey waka wit four legs for ground.
21. But una fit chop insects wey dey fly and wey dey waka wit four legs, and wey dia leg join for up—so dat dem fit jump.
22. Una fit chop any kind of locust, crickets, plus grasshoppers.
23. All di oda insects wey dey fly and wey get four legs na tufiakwa for una.
24. Dis insects go make una no clean. Any pesin wey touch dia deadbody no go clean until evening,
25. And any pesin wey pickup any of dia deadbody must wash hin clothes, and di pesin no go clean until evening reach.
26. Everi animal wey under hin leg go divide finish like malu leg, or wey no dey bring food back from belle to chew—dat animal no clean for una. Any pesin wey touch di deadbody of dem—no go clean.
27. All di animals wey get fingers like dog—among di animals wey dey waka wit four legs—no dey clean for una. Any pesin wey touch dia deadbody no go clean until evening.
28. Any pesin wey carry di deadbody of dat kain animal must wash hin clothes and di pesin no go clean until evening. Dis kain animals no clean for una.
29. All dis animals wey dey crawl for ground no clean for una: mole, mouse, any kind of big lizard,
30. Geko, monitor lizard, normal lizard, skink, and chameleon.
31. All dis animals no clean for una among di animals wey dey crawl. Any pesin wey touch dia deadbody no go clean until evening.
32. If any one of dem die, con fall on sometin, dat tin no go clean. Dem must rinse di tin wit water—any wood, cloth, leather, sackcloth, or tool for work. And di tin no go clean until evening reach. Na den e go con clean.
33. If any of dem fall inside clay pot, everitin wey dey inside no go clean,una must break di clay pot
34. Any food wey di water from dat clay pot touch, di food no go clean, and any drink wey dey for inside dat kain container no go clean.
35. Anytin wey dis deadbody fall on no go clean. If na clay stove, dem must brake am; e no clean and e no go ever clean for una.
36. But water wey dey flow from ground or well go clean, and any pesin wey touch deadbody inside di water no go clean.
37. If deadbody fall on any seed wey dem wan plant, di seed clean;
38. But if di seed wet wen di deadbody touch am, e no clean for una.
39. If animal wey you wan chop con die, any pesin wey touch di deadbody of di animal no go clean until evening reach.
40. Any pesin wey chop from di dead meat no clean until evening and di pesin must wash hin clothes, and any pesin wey carry di dead meat must wash hin clothes, and di pesin no go clean until evening.
41. Everi animal wey dey creep for ground na tufiakwa, una must no chop am.
42. No chop any animal wey dey move for ground, wether e dey crawl wit e belle, or e dey waka wit four legs; becos those kain animals na tufiakwa.
43. No corrupt yousef wit any animal wey dey crawl, make e no be sey una no go clean becos of dem.
44. Becos na me be Baba-God una Oga; and you must make yoursef holy, becos I holy. Una must no corrupt unasef wit any animal wey dey crawl for ground.
45. Na me be Baba-God wey carry una komot from di land of Egypt so dat I go be una God; so make una holy, becos I holy.
46. Na dis be di law about animals, birds, everi animal wey dey move inside water, and all di animals wey dey crawl for ground.
47. Una must separate wetin clean from wetin no clean, and separate animals wey una no fit chop, from di ones wey una fit chop.’ ”