Deuteronomy

Deuteronomy Chapter 5

Abeg click here to share dis post

       Di Agreement For Horeb

  1. Moses gada all di pipo of Israel con tok sey, “Make una listen well, oh pipo of Israel, listen to Baba-God  word and di laws wey I dey tell una today. Learn dem and make sure sey una follow dem, con do dem.
  2. Baba-God wey be awa Oga make agreement wit us  for Horeb.
  3. No be awa papa nahin Baba-God make agreement  wit but na wit us, na wit all of us wey dey alive today.
  4. Baba-God follow una yarn face to face from inside  faya on top of mountain.
  5. For dat time, I stand between Baba-God and una, and to show una Baba-God word, becos una bin dey  fear di faya and una no gree climb di mountain. And he tok sey:
  6. “Na me be Baba-God wey be una Oga wey carry una  komot from Egypt, komot from di land where una be  slaves.
  7. “Make una get no oda gods apart from me.
  8. “Make una no make any idol for unasef wey resemble anytin for heaven wey dey for up or for  earth wey dey down, or for inside water wey dey  under di earth.
  9. Make you no bow down to dem, or worship dem— becos me, Baba-God una Oga, na God wey dey jealous—wey dey punish pikin for di sins of dia papa go reach di third plus fourth generation of those pipo wey hate me,
  10. But I dey sorry-for thousands of generations of those pipo wey love me, and wey dey do wetin I tell dem to do.
  11. “Make una no use Baba-God una Oga Name take play, becos Baba-God no go free any pesin wey use hin name take play.
  12. “Observe di Sabbath day by keeping am holy as  Baba-God una Oga tell una to do.
  13. Make una work for six days, con do all una work,
  14. But di seventh day na Sabbath day to Baba-God wey be una Oga. Make una no do any work on dat day—both una plus una pikin, or even una house-boys and house-girls, or una animals, or di foreigners wey dey around una, so dat una workers fit rest as una take dey rest sef.
  15. Make una no forget sey una bin dey do slave work for inside Egypt, and Baba-God una Oga carry una komot from there wit strong hand and hin hand wey  stretch out. So Baba-God wey be una Oga don command una make una keep di Sabbath day.
  16. “Respect your papa and your mama, as Baba-God wey be una Oga don yarn una, so dat you go fit live  long, and so dat e go beta for you for di land wey Baba-God dey give una.
  17. Make una no kill.
  18. Make una no climb pesin husband or wife.
  19. Make una no tiff.
  20. Make una no lie for una neighbour head.
  21. “No let your eyes-shuuk for your neighbour wife. No let your eyes-shuuk for your neighbour house or land, or  hin horse-boys or house-girls, or hin animals, or anytin wey belong to your neighbour.”
  22. Dis na di words wey Baba-God tok wit loud voice to  all of una wey gada for there, for on top of di mountain, and from inside faya, wit cloud plus di thick darkness; and he no tok any oda tin. He write dem on top of two stones, con carry dem give me.

Di Pipo Fear As Baba-God Show-face

23. E con happun sey, wen una hear di voice from inside di darkness, as di mountain dey burn wit faya, una come meet me, even all di leaders of una  tribes and una senior-men come meet me;

24. And una tok sey, “Baba-God awa Oga don show us hin levels and hin big pawa. We don hear hin voice  from inside di faya. We don see sey pesin no die even if Baba-God follow am tok.

25. But why we go con die now? Dis heavy faya go burn  us, and we go die if we kontinu to hear Baba-God awa Oga voice.

26. Becos who among men don ever hear Baba-God  voice—wey dey live con survive am?

27. Make you go near, con listen to everitin wey Baba-God awa Oga dey yarn. Den you go tell us anytin wey Baba-God awa Oga tell you. We go listen, con  do am.”

28. Baba-God hear una wen una follow me tok, Baba-God con tell me sey, “I don hear wetin dis pipo dey tell you. Everitin wey dem tok dey good.

29. How I wish sey dia hearts fit move to fear me con always keep all my commandments, so dat e go beta for dem plus dia pikin forever!

30. Go, tell dem sey make dem go back to dia tents. But  make you stay for here wit me so dat I go tell you all  di commandments, di words and laws, wey you go teach dem—to do for di land wey I go give dem to claim as dia property.

31. So make una calm down to do wetin Baba-God una Oga don tell una to do; no turn go right or left.

32. Follow all di ways wey Baba-God una Oga don command una, so dat una go live, and so dat e go beta for una, and so dat una days go brekete for di  land wey una go claim.

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website