Joshua

Joshua Chapter 21

Abeg click here to share dis post

Di Cities of Di Levites

  1. Now di chiefs of di family of di Levites go meet Eleazar di priest, Joshua wey be di son of Nun, and di heads of di tribes of Israel—
  2. for Shiloh for Cannan, con tell dem sey, “Baba-God tell Moses sey make he give us cities wey we go dey stay, wit farmland for awa animals around di cities.”
  3. So just as Baba-God bin yarn, di pipo of Israel give di Levites dis towns, plus dia farmland out of dia own share of di land.
  4. Di first lot na for di families of di Kohathites from di sons of Aaron wey be priest, wey be from di tribe of Levi—dem share land to dem wit lot from di tribe of Judah, from di tribe of Simeon, and from di tribe of Benjamin—thirteen cities all togeda.
  5. Dem give di rest son of Kohath—ten cities from di families of di tribe of Ephraim, Dan, plus di half-tribe of Manasseh.
  6. Dem give di sons of Gershon thirteen cities, from di families of di tribes of Issachar, Asher, Naphtali, and from di half tribe of Manasseh for Bashan.
  7. Dem give di sons of Merari, family by family—twelve cities from di tribes of Reuben, Gad and Zebulun.
  8. So di pipo of Israel share dis towns to di Levites and farmland as Baba-God bin tell Moses.
  9. From di tribes of Judah and Simeon, dem give dis cities wey dia names dey here so,
  10. to di sons of Aaron wey be from Kohathite families inside di tribe of Levites; becos na dem get get di first lot*.
  11. Dem give dem di city of Arba, di papa of Anak [wey be Hebron], wit di farmland wey dey around am for mountain of Judah.
  12. But dem give di lands plus villages wey dey around di city—to Caleb wey be di son of Jephunneh, as hin share.
  13. So dem give Hebron and Libnah, plus di land wey dey around dem, to di sons of Aaron wey be priest—as city for hiding, for pesin wey kill anoda pesin.
  14. Jattir, Eshtemoa, plus di land wey dey around dem,
  15. Holon, Debir, plus di land wey dey around dem,
  16. Ain, Juttah plus Bethshemesh, togeda wit dia farmland wey dey around dem—nine cities from those two tribes.
  17. And from di tribe of Benjamin, dem give dem Gibeon, Geba—togeda wit di farmland wey dey around dem.
  18. Anathoth plus Almon, togeda wit dia farmlands wey dey around dem—four cities.
  19. All di cities of di sons of Aaron, di priests, na thirteen cities, togeda wit dia farmland wey dey around.
  20. From di tribe of Ephraim nahin dem take share land give di rest of di Kohathite families of Levites:
  21. Dem give dem Shechem from di mountain of Ephraim, plus di land wey dey around—as city for hiding—for pesin wey kill pesin, dem give dem Gezer sef—plus di farmland wey dey around,
  22. Kibzaim plus Bethhoron, togeda wit dia farmland—four cities.
  23. Evensef from di tribe of Dan, dem collect Eltekeh, Gibbethon—wit dia farmland wey dey around.
  24. Aijalon plus Gath-rimmon, togeda wit dia farmland—four cities.
  25. From di half-tribe of Manasseh, dem give dem Taanach, Gathrimmon, togeda wit dia farmland—two cities.
  26. All di cities na ten, togeda wit dia farmland—nahin dem give di rest of di Kohathite families.
  27. Dem give land from di half-tibe of Manasseh to di Levites families of di Gershonites. Dem give dem Golan for Bashan wit di farmland wey dey around—as city to kpanji [city to hide] for pesin wey kill anoda pesin, plus Eshtarah, togeda wit dia farmland—two cities;
  28. From di tribe of Issachar; Kishion, plus Daberath—wit di farmland wey dey around dem.
  29. Jarmuth plus En-Gannim, togeda wit dia farmland wey dey around dem–four cities.
  30. From di tribe of Asher; Mishal, plus Abdon—togeda wit dia farmland wey dey around.
  31. Helkath and Rehob, togeda wit dia farmland wey dey around dem—na four cities.
  32. From di tribe of Napthali; Kadesh for inside Galilee wit dia farmland wey dey around—as city for hiding for pesin wey kill anoda pesin. And Hammothdor plus Kartan, togeda wit dia farmland—three cities.
  33. All di cities of di Gershonites, based-on dia families, na thirteen, togeda wit dia farmland wey dey around dem.
  34. Di Merarite families wey be di rest of di Levites receive land from di tribe of Zebulun; Jokneam and Kartah—wit dia farmland wey dey around,
  35. Dimnah plus Nahalal, togeda wit dia farmland wey dey around—na four cities;
  36. From di tribe of Reuben; Bezer and Jahaz—wit dia farmland wey dey around.
  37. Kedemoth and Mephaath, togeda wit dia farmland wey dey around dem—four cities;
  38. From di tribe of Gad; Ramoth for inside Gilead wit di farmland wey dey around—as city for hiding, for pesin wey kill anoda pesin. And Mahanaim wit di farmland wey dey around am.
  39. Heshbon plus Jazer, togeda wit dia farmland wey dey around dem—all of dem na four cities.
  40. All di cities wey dem share give di Merarite families wey be di rest of di Levites, na twelve cities.
  41. All di cities of di Levites for inside di land of di pipo of Israel na forty-eight all togeda, togeda wit dia farmland wey dey around dem.
  42. Everi single one of di cities get farmland wey surround am; naso all dis cities be.

Baba-God Do Wetin He Promise

43. So Baba-God give Israel all di land wey he swear sey he go give dia papa-papa-papa, and dem claim di land, con start to dey stay for there.

44. Baba-God give dem rest for everi corner, just as he bin swear to dia papa-papa-papa. No single one of dia enemies fit stand for dia front; Baba-God put all dia enemies for dia hand.

45. Out of all di beta-beta promises wey Baba-God promise di pipo of Israel, no single one of dem wey no happun.

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website