Judges Chapter 2
Di Pipo Of Israel Disobey
- Baba-God angel move from Gilgal to Bokim, con tok sey, “I carry una komot from Egypt, con carry una enta di land wey I swear to give una ancestors. I tok sey, ‘I no go ever break my agreement wit una,
- And make una no make any agreement wit di pipo of dis land, but make una break dia altars.’ But una no gree obey me. Why una do like dis?
- So now I dey yarn una sey I no go pursue dem komot from una front, but dem go be like shuuku-shuuku for una sides, and dia gods go be trap for una.”
- Wen Baba-God angel tell di pipo of Israel all dis tins, di pipo raise dia voice, con dey cry;
- So dem call dat place Bokim. Na for there dem give sacrifice to Baba-God.
As Joshua Take Kpeme
6. Afta Joshua don discharge di pipo of Israel, dem go take-over di land, everi one of dem go dia own share.
7. Di pipo serve Baba-God tru-out di life of Joshua, and di senior-men wey live pass Joshua, wey don see all di ogbonge tins wey Baba-God do for Israel.
8. Joshua wey be di son of Nun, di servant of Baba-God die wen he be hundred and ten years old.
9. Dem bury am for di land wey be hin own share, for Timnathheres, for di mountains of Ephraim, for di north side of Mountain Gaash.
10. Afta dat whole generation kpeme, con join dia ancestors, anoda generation grow wey no sabi Baba-God or di tins wey he do for di pipo of Israel.
Dem Turn Komot From Baba-God
12. Dem fashi Baba-God, di God of dia ancestors wey carry dem komot from inside Egypt. Dem con dey worship oda gods—di gods of di pipo wey dey around dem. Dem bow down for di gods, con make Baba-God vex.
13. Naso dem fashi Baba-God, con dey worship Baal plus Ashtaroth.
14. As Baba-God dey vex for Israel, he carry dem give pipo wey raid dem and wey obtain dem. He sell dem for dia enemies wey dey round dem—sote dem no fit fight dia enemies again.
15. Wen Israel komot go fight, naso Baba-God hand con dey against dem to beat dem, just as he bin swear to dem. Na serious wahala dem con dey face.
16. But Baba-God raise judges wey save dem from di hands of di pipo wey dey raid dem.
17. But dem no still listen to dia judges, but dem con dey follow oda gods like ashawo pipo and dem bow down for oda gods. But no be like dia ancestors wey obey Baba-God word—dem sharply turn komot from di way wey dia papa-papa-papa bin dey follow, dem no gree follow wetin Baba-God tok.
18. Any time wey Baba-God raise judge for dem, Baba-God go dey wit di judge and he save dem from di hands of dia enemies as long as di judge dey alive; becos Baba-God sorry-for dem as dem dey cry under di pipo wey dey oppress and suffer dem.
19. But wen di judge die, di pipo go go back to di ways wey even corrupt pass di ways of dia papa-papa-papa—con dey follow oda gods and dey serve and worship dem. Dem no gree komot hand from dia evil and stubborn ways.
20. So Baba-God con dey vex for Israel, so he tok sey, “Becos dis nation don break my agreement wey I set for dia papa-papa-papa [ancestors], and dem no gree listen to me,
21. I no go pursue any of di nations again komot from dia front—di nations wey Joshua bin leave wen he die.
22. I go use dem take test Israel, con see if dem go keep Baba-God way, con waka inside am as dia papa-papa-papa bin do.”
23. Na Baba-God let those nations remain for there; he no pursue dem komot at onces by giving dem to Joshua hand.