Psalm Chapter 6
Prayer For Mercy Wen Yawa Gas
- For di music producer. Play am wit
music instrument wey get string. Harp wey
get eight strings. Dis na Psalm of David. Oh
Baba-God, no punish me as you dey para, or
correct me as your vex dey hot. - Baba-God sorry-for me, I no- strong; Oh
Baba-God, heal me, my bones dey shake wit
fear. - My soul dey face serious yawa. But you,
oh Baba-God, how long? - Chai Baba-God, turn save my soul; chai, save my life—becos you dey sorry-for pesin.
- No-pesin fit remember you wen e don
kpeme. Who fit tank you for inside grave? - I don taya to dey cry; for night I dey cry
river on top my bed—con soak my pillow
wit water from my eyes. - My eyes dey pain me becos of too much
cry-cry; my eyes dey close becos of my
enemies. - Oya komot for my side, all of una wey
dey do evil tins, becos Baba-God don hear
my voice as I dey cry. - Baba-God don hear my cry for epp;
Baba-God go hear my prayer. - Make shame catch all my enemies, and
make wahala burku for dia head; make dem
turn back, and make shame catch dem now-now-now.