Psalm (Pidgin Bible)

Psalm Chapter 8

Abeg click here to share dis post

Baba-God Levels, Plus Di Respect Of
Man

  1. To di Producer of music. On di musical
    instrument of Gath. Dis na Psalm of David.
    Oh Baba-God awa Oga, see as your name na
    ogbonge for di whole earth! You don set your
    levels high pass heaven!
  2. From di mouth of small-small pikin, and
    pikin wey dey suck breast—nahin you don
    put your pawa, becos of your enemies, so dat
    you go silence your enemies, plus di pipo
    wey dey fight you.
  3. Any time I reason di heavens, plus di
    works wey your fingers make, di moon plus
    di stars, wey you don set for dia place,
  4. who be man wey you dey tink about am?
    Who be m a n pikin—wey you con dey
    reason hin mata?
  5. You make am low pass angels—small,
    you crown am wit levels plus respect.
  6. You make am control all your handwork;
    you don put everitin under hin leg:
  7. All di sheep and malu, plus di wild
    animals wey dey for bush,
  8. di birds wey dey fly for air, plus fish wey
    dey for water, plus all animals wey dey swim
    for inside di big-river [sea].
  9. Oh Baba-God awa Oga, see as your
    name get levels for di full earth!

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website