Psalm Chapter 9
Tanks-giving For Baba-God Justice
- To di music Producer. To di tune of “Di
death of di Son.” Dis na Psalm of David. Oh
Baba-God, I go salute you wit my whole
heart; I go tok about all your ogbonge works. - I go dey happy, con dey celebrate inside
you; I go sing praises to your name—Oh
Most High. - My enemies turn back; dem go fall—con kpeme for your front.
- Na you epp me fight for my right and my business; you don sidon for your king-chair, and you dey judge in di right way.
- You don change-am-for di nations, con scata wicked pipo; you don komot dia name throway for ever and ever.
- Scata-scata wey no dey finish don catch di enemy; you don scata cities and no-pesin go remember dem again.
- But Baba-God dey-on-board forever; he don arrange hin king-chair for judgement.
- He go judge di world wit hin church-mind; he go judge di nations wit justice.
- Na Baba-God dey protect pipo wey dem dey oppress, na inside Baba-God pipo dey hide dia head put—wen yawa gas.
- Those pipo wey know your name go trust you, Oh Baba-God, becos you no dey ever fashi pipo wey dey fyne you.
- Sing praises to Baba-God—wey dey stay for Zion; tell di nations about hin handwork.
- Baba-God wey dey revenge against killers—dey remember dem; Baba-God no dey forget di cry of poor pipo.
- Chai Baba-God, sorry-for me, reason di wahala wey I dey face from pipo wey hate me, you wey carry me komot from di teeth of death,
- so dat I go fit tok about your praise—for front of di gates of Zion, and I go happy sey you save me.
- Di nations don fall inside di hole wey dem dig; di net wey dem set—don hook dia own leg.
- Everi-pesin know Baba-God—for hin justice; wicked pipo handwork dey put dem for trap.
- Wicked pipo dey go straight to grave—plus all di nations wey fashi Baba-God.
- But Baba-God no go always fashi pipo wey need epp; poor pipo no go lose hope forever.
- Stand up, Oh Baba-God, no let ordinary man win you; judge di nations for your front.
- Make fear catch dem, Oh Baba-God! Make di nations know sey dem be ordinary men