Psalm Chapter 13
Dis Na Prayer For Epp
- For di producer of music. Dis na Psalm of David. Oh Baba-God, how long you go fashi me forever? How long you go dey hide your face from me?
- How long I go dey reason inside my soul, and palava dey inside my heart everi day? How long my enemies go dey feel-big for me?
- Reason me make you ansa me, Oh Baba-God my Oga. Shine light for my eyes, or I go sleep inside death;
- or my enemy go con tok sey, “I don win am,” and my enemies go celebrate if I fall.
- But I don trust sey you go sorry-for me, and my heart dey happy sey you save me.
- I go sing for Baba-God, becos he don
bless me well-well.