Psalm (Pidgin Bible)

Psalm Chapter 18

Abeg click here to share dis post

Dis Na Song Of Victory

  1. For di producer of music. Dis na Psalm of David—servant of Baba-God, wey use di yarnings of dis song follow Baba-God tok, di day wey Baba-God save am from di hands of
    hin enemies, and from di hands of Saul. And he tok sey: I go love you, Oh Baba-God wey be my pawa.
  1. Na Baba-God be my rock, my strong-house, and saviour; Baba-God na my pawa wey I go trust, na my guard, and di horn wey dey save me, plus my secure place.
  2. I go call Baba-God wey get levels to
    receive my praise, and naso I go save from my enemies.
  3. Di pain of death tie round me, and di
    wave of evil make my mind-cut.
  4. Di sorrow of grave tie round me; trap of death jam me face to face.
  5. I call Baba-God for inside my palava; I
    cry to Baba-God for epp. He con hear my voice from inside hin worship-place; my cry enta inside hin ears.
  6. Di earth con dey shake and fear, di
    foundations of di mountains move and shake; dem shake becos Baba-God dey vex.
  7. Smoke dey komot from hin nose; faya
    wey dey burn to ashes dey komot from hin mouth—coal wey dey burn come out from am.
  8. He open di heaven, con come down; dark clouds dey under hin leg.
  9. He climb on top of Cherubim con fly; he fly on top of di feathers of di heavy-breeze.
  10. He use darkness take hide hinsef, and di canopy wey dey round am na dark water, plus thick cloud of di sky.
  11. From inside di brightness wey dey round am, hin thick clouds dey move dey go wit ice-stone, plus coal of faya.
  12. Baba-God halla from heaven like
    thunder; and di Most High raise hin
    voice—ice-stone plus coal of faya.
  13. He shoot hin arrow, con dabaru di
    enemies, plenty lightning, and he win dem.
  14. Pipo con see di bottom of di big-river,
    and even di foundation of di earth open wen you halla, Oh Baba-God—wen you sound di breath from your nose.
  15. From up-up he use hin hand carry me
    from ground; he drag me komot from inside di plenty water.
  16. He save me from my strong enemy, from pipo wey hate me—wey get pawa pass me well-well.
  17. Dem face me for di day wen yawa gas, but na Baba-God be my support.
  18. He carry me komot—go place wey get
    beta space; he save me becos he like me well-well.
  19. Baba-God don bless me based- on my
    clean-heart; he don pay me based-on how my hand take clean reach.
  20. I don follow Baba-God ways; I neva use wickedness fashi Baba-God.
  21. All hin laws dey wit me; I neva fashi hin laws.
  22. He no see error wit me, and I don keep myself from sin.
  23. Baba-God don bless me based-on my clean-heart; and based-on how my hand-clean reach for hin eyes.
  24. You dey sorry-for pipo—wey dey sorry-for pesin, and you dey show your perfect ways to pipo wey no get error.
  25. You dey show your pure way to pipo wey dey pure, and you dey handle wayo-pipo in a rugged way.
  26. You dey save humble pipo, but you bring down those pipo wey dey feel-big for dia eyes.
  27. Oh Baba-God, you go light my lamp; Baba-God my Oga go turn my darkness to light.
  28. Wit your epp I fit go fight plenty sojas; wit my Baba-God, I fit jump wall.
  29. As for Baba-God, hin way dey perfect; Baba-God word na confam. He be guard to everi- pesin wey trust am.
  30. Who be God apart from Baba-God? Who be di Rock apart from awa Baba-God?
  31. Na Baba-God dey give me pawa like weapon, and he dey make my way perfect.
  32. He make my leg be like deer leg, and he make me stand for high place.
  33. He teach my hand how to fight war, so dat I fit use my hand take break bow of bronze.
  34. Na you be di guard wey dey save me; and your right hand nahin dey maintain me; your jeje way don make me great.
  35. You open road under my leg, so dat I no go dror-fall for ground.
  36. I don pursue my enemies, and I overtake dem; I no turn back until I scata all of dem.
  37. I don wound dem—sote dem no-fit stand up again. Dem don fall under my leg.
  38. You put pawa for my hand to fight. You don put my enemies under my leg.
  39. You don give me di neck of my enemies, so dat I go scata those pipo wey hate me.
  40. Dem cry for epp, but no-pesin dey to save dem—dem even cry to Baba-God, but he no ansa dem.
  41. I con grind dem like dust wey breeze dey blow; I throway dem like yama-yama for street.
  42. You don free me from di palava of pipo; you don make me di head of di nations. Pipo wey I no know before go serve me.
  43. Naso dem dey obey me as dem just hear about me; foreigners dey obey me.
  44. Foreigners mind dey cut; dem dey shake as dem dey come from dia strong-house.
  45. Baba-God dey alive! Blessings for my rock! Make Baba-God wey save me—get level!
  46. Na Baba-God dey revenge for me, and he put nations under my control.
  47. He dey free me from my enemies; yes, you don carry me up-up—pass di pipo wey dey rise against me; you don save me from men wey love to kill.
  48. Oh Baba-God, I go give tanks to you among di nations—and I go sing praises to your name.
  49. He dey give hin King ogbonge victory; he dey sorry-for di pesin wey He anoint, to David and hin pikin-pikin-pikin forever.

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website