Psalm Chapter 27
Dis Na Prayer Of Praise
- Dis na Psalm of David. Na Baba-God be my light and nahin dey save me, who I go con dey fear? Na Baba-God be di pawa of my
life—who go con dey make me fear? - Wen evil men and my enemies carry
wahala come—to chop my flesh, wen my enemies and badbelle pipo attack me, dem fall yakata for ground. - Even though plenty soja gada round me, my mind no go cut; even if dem start war against me, na dat time I go get full-mind.
- Na one tin wey I dey ask from you
Oluwa, dis na wetin I dey fyne: sey make I dey inside Baba-God house all di days of my
life, make I fit see as Baba-God beautiful reach, and to fyne am inside hin worship-place. - He go keep me safe inside hin house wen di day of wahala show; he go hide me inside di coded place of hin worship-place—con carry me high on top of rock.
- Naso he go carry my head high—pass di enemies wey surround me; so I go give am sacrifice of happiness for inside hin house; I go sing…eehn…I go sing praises to Baba-God.
- Hear my voice wen I call you, Oh Baba-God; sorry-for me sef—con ansa me.
- Wen you tok sey, “Look my face!” My
heart tok sey, “Na your face I dey look Oh Chineke.” - No hide your face from me, no pursue
your servant komot as you dey vex; e don tey wey you don dey epp me. No leave me or fashi me, Oh Baba-God wey dey save me! - Even wen my mama and papa fashi me, na den Baba-God go take care of me.
- Oh Baba-God, teach me your ways;
carry me pass your smooth road—becos of my enemies. - No let me fall for my enemy wish. Pipo wey dey lie for my head don stand up to change-am-for me, di air wey dem dey breath na fight-fight.
- I for don lose heart if to sey I no believe sey I go see Baba-God goodness for di land of di living.
- Wait for Baba-God; get full- mind, and
he go give your heart pawa, I sey—wait on Baba-God.