Psalm Chapter 33
To Dey Praise Baba-God
- Pipo wit clean-heart, make una jolly
inside Baba-God; e dey beautiful for pipo
wey get clean- hand to praise Baba-God. - Praise Baba-God wit harp; compose music for Baba-God wit ten-string instrument.
- Sing new song to Baba-God; use your
skill play music for am, and shout wit
jubilation. - Baba-God word dey right and everitin
wey he dey do na wit truth. - Baba-God love pure heart and justice; di earth brekete wit Baba-God goodness.
- Na Baba-God word nahin he take make di heavens, na di breath of hin mouth form all di stars, moon, plus everi-everi wey dey for sky.
- Baba-God don gada all di water of di big-rivers togeda; he keep di big-big-river inside hin pocket.
- Make everi-pesin wey dey for earth fear Baba-God; make all di pipo of di world stand to cut-cap for Baba-God.
- He tok and wetin he tok don happun; he command tins and di tins wey he command stand gidigbam.
- Baba-God dey scata di ideas of di
nations; he dey make dia plans dey useless. - But Baba-God plans dey stand gidigbam forever, and di plan for hin heart go stand for all generations.
- Blessings for na di nation wey make
Baba-God dia Oga, and di pipo wey he don choose as hin own pipo. - From heaven nahin Baba-God take dey look down, and he dey see everi man; from where he dey stay, he dey watch all di pipo wey dey live for di earth.
- Baba-God wey dey form everi- pesin
heart—he dey reason everitin wey dem dey do. - No king dey safe becos of how hin army and weapon plenty reach; strong man no dey escape becos of how he get pawa reach.
- No waste your time dey hope sey na your horse go save you; even as e get pawa reach, e no-fit save any-pesin.
- See! Baba-God eyes dey watch all those pipo wey dey fear am, and those pipo wey dey hope on am to sorry-for dem,
- To save dem from death and to keep dem alive wen hunger full town.
- Awa soul dey wait for Baba-God wit
hope; nahin be awa epp and guard. - Awa heart go jolly inside Baba-God
becos we don trust Baba-God holy name. - Oh Baba-God, sorry-for us—just as we
dey hope on you.