Psalm (Pidgin Bible)

Psalm Chapter 36

Abeg click here to share dis post

Di Badbelle Of Man

  1. Oracle dey for inside my heart about di bad tins wey wicked pipo dey do: Di fear of Baba-God no dey for hin eyes at all.
  2. For hin own eyes, he dey whyne hinsef
    well-well sote he no-fit see, or hate hin sin.
  3. Di tins wey he dey tok na evil plus wayo; he no wan gree get- sense, and he no wan gree do good tin.
  4. He dey plan evil on top of hin bed; he don shuuk-hand for evil runs, and he no hate wrong tin.
  5. Oh Baba-God, your mercy reach heaven, your faithfulness reach di sky.
  1. Your goodness be like big mountains,
    your justice be like di big-big-river dey deep; oh Baba-God, na you dey keep both men, plus wild animals.
  2. Oh Baba-God, your soft-love dey
    precious well-well! So man pikin dey put dia trust under di shadow of your feathers.
  3. Dem dey chop belleful from di yanfu-yanfu wey dey for your house; and you dey give dem drink from di river wey you like.
  4. Di water of life wey dey f low— dey
    inside you; na inside your light we take dey see light.
  5. Oh kontinu to show your soft- love to
    those pipo wey know you, and kontinu to show your goodness to pipo wey get clean-heart.
  6. Make men wey dey buga no march me for ground, and no let wicked pipo hand drive me komot.
  7. See as wicked pipo don fall down for
    ground—dem dey for ground and dem no go fit stand up again!

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website